That moment you realized that you are not your lover’s lover.
Wait fess, so you nor be your babe guy? 😃
Imagine you’d feel if your lover told you they were not around, only for you to go to a bar to have a drink and clear your head… and
Surprise… surprise, you found her there with someone else – a guy.
Shebi e go be like say na bad dream.
Only you go dey wish say make e nor be true.. That shii would fvck your emotion up differently if you truly love her.
E go be like say heart attack wan hold you.
Cos the whole place dey rotate for your eyes.
It is in that moment all the red flags you’ve ignored will start replaying in your head.
One mind wee na be laughing you, calling you a Mumu man (you dunno nothing).
You were blindly and foolishly in love. You go even lose appetite, instanta.
Dis one na babe wey you dun wed for your mind already o… even if you neva propose to her for real-life sef. (Chai)
“Bar man, abeg gimme me one chilled bottle.”
Barman bring the bottle.
Na so you tey drink, hoping say e go make your head clear, or wake you up from the bad dream.
But, nothing!
Na real life you dey, no be nightmare.
You go con raise am.
Order for another one.
Before you know it, you haven’t drunk more than 2 bottles in your entire life before,
You dun down 6ix bottles and still dey signal barman for more.
E con be like say your Imagination go dey cleaf small small.
Na then you go con realize say those times wey your guys dey jokingly call you mugu, na the actual truth dem dey talk.
Eh God! 💔😅
While your mind is running wild in different directions, then you’d remember the last time you both made love.
You go con dey reason how she tey sweet – sweet in the middle.
All these while you dey compose yourself o.
“man nor dey cry,” you’d tell yourself in consolation, maintaining composure
Until the thought of how she screams your name while her kitty squeeze n cream ur lil soldier hits you.
Damn!
*sniffs**
first tear drops,
you go clean am, say maybe na pepper enter your eyes. (Hard guy nor dey cry)
2nd tear drops,
you clean am, ”
“e be like say na the onions wey i slice yesterday dey make me cry now so o,” you would say in defense. (bros wee you keep kwayet?)
Cry in peace joor.
Na break, your heart break, your nor kee person. 😅
And when the barman brought the 8th bottle and noticed the tears flowing from your eyes…
” Hello sir, is everything okay?,” he asked, concerned.
” What kinda question is that? Do I look like everything is not alright? Ogbeni mind your business oh, make i nor change am for you,
if na your babe anoda person thief, shey you go dey alright ni,” you wee want to reply bt…
You nor fit just cast yourself like dat nau.
” I’m cool bruv,” you wee reply, with that ‘mind your fvcking business’ look on your face.
While you are forming James Bond for innocent barman, you go con see as the guy dey kiss your babe, sorry, ex babe I mean.
She go con smile, smile like goat head for ukodo pepper soup. 😁 🤣
“So na dat guy go dey enjoy her now?”
“Where I tey fuck up?”
“But me and her nor get any issues before o, we even talk well yesterday night na…. Wetin dey occur??
You’ll just be asking yourself questions and trying to look for answers in your head.
The next thing wey go sup be say,
You dun dey cry, dey laugh. 😅
E con be like say na crase wan start so… (chai, village people why today?)
Small small, people go dey observe you with style, dey reason weda make dem come tie you with rope or not…
Cos at that point, you’d look like a potential threat.
Cos with 8 empty bottles on your table, tears streaming than your face while you laugh like you’re going nuts…
Their mind no suppose settle.
Cos who knows, dem fit dey reason say you go pick bottle tey burst person head for that mood.
So, dem get right to look you suspiciously with intentions to tie you with rope.
A whole you o.
See wetin heart break fit cause.
Damn! 💔😅
Omo, you shouldn’t be the imaginary bros in this story oh.
Nor go let “I too love her” make you drink sniper con go die incase ona relationship cast oh
Because…
If you die cos of heartbreak, na you lose.
So while you love with your heart, use your brain too.
Dem say “love dey turn person to mumu” dat one na lie from the deepest part of hell.
You don’t just accept every cliche.
Use your headquarters. 🧠
Love will get us soft and vulnerable in a relationship because there’ll enough room for compromises, but…
You should know when your lover is being manipulative or fooling around.
There’ll always be signs that’ll warn – ALWAYS.
But, na you go choose to ignore am cos you like to live in delusion than face reality.
And na why e go even mess with your head pass be dat – ignoring your instincts.
Love your lover with your heart until they give you a reason to stop.
And when you see the writings on the wall that they are no longer interested in sailing the relationSHIP with you…
Take your L in peace and cut em off.
Yes, e go pain you at first o.
Especially if you guys have been together for a while and created great memories.
Omo, na the memories go pain your pass sef
Cos you must have made future plans together that you look forward to.
But…
You just have to get yourself to trash those memories from your head space, even if it’ll hurt for the meantime.
No reason am.
A broken relationship will always be better than a broken home – anytime, any day.
So, cheer up.
Continue to dey work on yourself.
And with time, you go heal and move ahead.
Heal so dat you no go carry the hurt and pain tey bleed on another person.
Heal o, heal.
I mean, make sure say you heal.
No go rush enter new relationship cos you wan fill her void – or prove to her say you dey hot.
You’ll only succeed in damaging yourself and complicating things more – for yourself.
So,heal.
Understand the part you play for the break-up.
Fix your flaws.
Develop your character.
And with time, you’ll become a better version of yourself – that’ll attract better people to you.
You’ll be fine.
Remember say…
Relationship na “lean on me” nor be “press me die” ( shey you get?).
I know say you smart sha.
Stay Sharp,
Efe