Breathe

Sometimes, all you can do is just breathe, sleep, and recharge so you can have strength to try again.

Because…

If you too reason some kine blows life go deck you ehn , you fit ment or fall enta depression.

Do you know how fucked up it could be when you’re doing the best you can but you aren’t getting the small of results – to keep you going?

Who no know wetin you dey go through fit think say you dey waste your life or say you lazy.

And even if you wan shalaye sef,

wetin be ur evidence?

It hurts, mheen! 💔🤦🏽‍♂️

Na why you go just dey do your thing dey go.

And why you must continue to believe in yourself- no matter wetin sup, because…

The moment you start to second-guess yourself and your abilities

That’ll be the beginning of your end.

Omo, be your biggest motivation o.

I want make you remember say even these hard times no go last forever – IF you continue dey push in the right direction.

E no go easy, but…

Who give up na e lose.

Wait fess o.

If you give up sef, wetin you wan con dey do?? 😶

You wan sit down dey look people wey dey grind to make their lives better?

No be so na.

You pass like dat o, paddy.

Anyhow life dey do you now, just dey rugged am dey go with focus on achieving your goals.

Find joy and happiness in the smallest things to keep you going.

Las las, Like Kendrick Lamar talk –

We Gon Be Alright!

 

Stay Sharp!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *