I heard tomorrow’s is Christmas 😃
And lots of people are putting themselves under unnecessary pressure to “activate”.
Why nau?
I spoke with a friend over the phone the phone the other day, and he said, ” I feel pressured because I’m yet to buy fowl.”
I fess burst laugh cos e be like joke, but there was seriousness in his voice.
” wetin dey worry you sef?,” I asked ” who make am mandatory say you must buy fowl for Christmas? Na chicken you never eat before abi na wetin?”
“You no go understand, dis one different. Na tradition wey dem born me come meet, I wan continue am ” he replied.
” Who start the tradition? Why dem start am in the first place? Why you think say you need to continue am against your balance?:
” omo, no dey ask many questions, na fowl I wan buy, not be to answer plenty questions. I go send my account number give you make tou send me money,” he said.
” You dun fvck up sha. Why you go use me tey test jazz? E go surely cast na. Now your money dun waste. You gats go renew am now.,” I replied.
” lol. You dun start. Which jazz? send the money make I go buy fowl joor.” He said.
” You just dey kill the potency of the jazz more. Cos if no be jazz tell me why you go dey use seriousness dey bill me? E no work na. Oya blow powder join fess weda e go work on me,” I replied, laughing out loud.
Omo, life no too hard laidat o, my guy, na we dey complicate am.
Cos chicken n turkey wey you dey eat regularly since, e reach December now, you turn am to “special one”, as as how na? 💔😅
For some people, it’s the pressure to buy new clothes, go on vacations, shut down clubs, or anything to impress others ( even at the detriment of their finances).
Saw a WhatsApp status that reads:
” we know your last Christmas wig o, if you like revamp am dis year we go know ” 😅
What in the foolery is that?
It might be a joke but some people take those things personally because of a fake image they’re trying to portray and maintain.
Another one I keep seeing is;
” So nobody love me enough to ask what I need for Christmas?”
Really?? Na you be “celebrant”?
Some people just love stressing themselves with unnecessary expectations and urge to keep up with the Jonses sha.
And na why all those sellers dey sell normal things at outrageous prices cos many people dey take dem as luxury for December.
It’s both funny and sad watching people get themselves under unnecessary pressure for a a festive celebration they don’t even know about its origin.
Oh wrong nau.
With your brain and composure, you dey allow some tradition dey mess you up?
As how na?
What’s the reason for your enlightenment now, if you can’t use it to improve the quality of your life?
Cos some problems we dey face today na because of some traditions wey our forefathers start out of ignorance
But, now that we’ve evolved and know that they did those things from a place of lack of exposure
Are we to continue practicing such traditions that aren’t helping us evolve?
No!
But ifbyou say “yes”, you are part of the problem we have in this world sha. ( Jsyk ).
Use your brain to make your life easy.
Whatever you’ve been doing that’s not helping you grow or improving the quality of your life…
Stop it immediately!
E Get Why.
Have an amazing festive celebrations with you and yours!
Stay Sharp!